Psalms 124 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishNa God Dey Protet En Pipol David Song 1 Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?” 2 If to sey God nor really dey awa side wen pipol attack us, 3 dem for don swallow us alive as dem dey vex. 4 River for don kover us; wota for don karry us go. 5 Strong wave for river for don kover awa soul. 6 So, make wi praiz God wey nor let awa enemies tear us to pieces with dia tit! 7 Wi don eskape like bird wey komot from hunta trap. Dia trap and net wey dem set for us, don break and wi don dey free! 8 God wey kreate heaven and eart, na-im diliver us from dia hand. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.