Psalms 123 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer For Mesi David Song 1 My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on. 2 Just as savants dey depend on dia masta and as savant girls dey depend on dia madam, na so wi too dey depend on di Oga awa God, until E go favor us. 3 My Oga God, make Yu sorry and pity for us, bikos wi too don get awa own share for di trobol. 4 Di wahala wey wi get, don taya us and awa trobol, plenty well-well. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.