Psalms 122 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPraiz Jerusalem David Song 1 I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.” 2 And na der wi dey naw, as wi stand inside Jerusalem. 3 Jerusalem na strong town wey dem build well; so nor-tin go fit skata en wall. 4 Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am. Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der. 5 Di throne where God for dey judge kase dey for der; di throne wey bi David and en shidren-shidren own. 6 So make una pray for peace for Jerusalem and evribody wey love am, go prosper. 7 My Jerusalem, make peace follow yu and yor palis go dey prosper forever. 8 Bikos of my family and friends, I go sey, “Make peace follow yu.” 9 Bikos of awa Oga God house, I go pray make Jerusalem dey prosper. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.