Psalms 121 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishNa God Dey Protet David Song 1 I go look up to di mountin! Where my help from dey kom? 2 My help dey kom from God, di Pesin wey make heaven and eart! 3 E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep. 4 True-true, di Pesin wey dey guide Israel nor dey sleep at-all at-all. 5 Na God ensef dey wosh ova mi! E stand near mi kon protet mi. 6 Di sun nor fit do mi anytin for day time or di moon for nite. 7 God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life. 8 God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.