Psalms 120 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer For Help David Song 1 Wen I dey face trobol, I kry to God and E ansa my prayer. 2 My God, make Yu save mi from pipol wey dey lie and deceive odas. 3 Una wey sabi lie well-well, una know how God go take ponish una? Una know how una wahala go plenty rish? 4 Dem go shuk una with sharp arrow kon burn una with hot shako from fire. 5 I really sofa for Meshak town and e pain mi well-well sey I stay with Kedar pipol. 6 I don taya to stay among pipol wey nor like peace. 7 I dey look for peace; but wen ever I tok about am, na war dem dey give mi. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.