Psalms 12 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishPrayer for Help David Song 1 My God, make Yu diliver mi! Bikos all doz wey dey fear and respet Yu, wiked pipol don kill dem finish. 2 Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef. 3 Make God kut di tongue wey dey tok anyhow kon distroy di mout wey dey boast! 4 Dem dey sey, “Na di way wi dey tok, dey make us prosper; na wi get awa own lip: who bi awa oga or who go fit stop us?” 5 So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.” 6 God promise dey pure well-well like silva wey dem melt for fire. 7 So Oga God, wi know sey Yu go protet doz wey dem dey opress. Yu go guide dem forever from doz pipol wey sabi lie well-well, 8 even from doz evil pipol wey dey evriwhere, bikos wikedness don kover di whole land. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.