Job 29 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishJob Still Dey Tok 1 Job still sey: 2 “If to sey my life go fit bi as e bi before wen God dey look and guide mi! 3 Dat time, God always dey with mi and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness. 4 Dat na di time wey evritin still dey well with mi. Den God goodness still dey protet my house. 5 Den God still dey with mi and all my shidren gada round mi. 6 My melu and goats dey give mi plenty milk and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong. 7 Wen ever di town eldas dey meet and I go der, 8 yong boys dey stand as soon as dem si mi dey kom and old pipol dey stand greet mi with respet. 9 Di leaders wey dey lead di pipol go stop to tok. 10 Even di pesin wey dey important pass, go shut up for mi. Job Dey Good Well-well 11 “Evribody wey hear from mi, dey praiz mi. Doz wey hear mi dey tok, go-go tok good about mi. 12 Wen poor pipol kry kom meet mi, I dey help dem; I dey help pikin wey nor get papa and mama and doz wey nor get where to go. 13 Doz wey dey face wahala, dey praiz mi and I dey protet and guide wimen wey dia husband don die. 14 I dey always do betta tin. Evritin wey I do dey always dey good. 15 Na mi bi blind pipol eye and doz wey nor fit waka, na mi bi dia leg. 16 I bi like papa to poor pipol and I dey setol matter even for doz wey I nor know. 17 I dey distroy wiked pipol pawa kon release di pesin wey dem katch. Job Get Mind 18 “Den I sey, I go get long life kon die for my house without trobol. 19 I go bi like tree wey en rut get wota; wey dew dey wet en branches. 20 Evribody go dey praiz mi and my pawa nor go fail. Job Good Karata 21 “Wen I dey advise pipol, dem dey kwayet listin to wetin I dey tok 22 and dem nor dey get anytin to tok wen I don tok finish. My word dey enter dia mind well. 23 Evribody dey welkom mi, just as farmer dey welkom rain wey won fall. 24 I dey smile give dem wey nor bilive diasef again and my betta face dey give dem hope. 25 I dey lead dem as king dey lead many pipol kon konfort dem wen dem dey face trobol. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.