Job 25 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishBildad Still Tok 1 Bildad kon sey: 2 “Na God get pawa pass. E keep en kingdom wey dey heaven for peace. 3 Anybody fit kount di angels? Abi e get where God lite nor dey shine rish? 4 Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure? 5 For God eye, even di moon nor brite and di stars nor shine rish. 6 Tok-less of human being wey just bi like worm and magot! Wetin dia life mean to God?” |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.