Job 23 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishJob Ansa Again 1 Job kon ansa: 2 “Today, my komplain still dey make my heart betta; I nor fit hold my bitterness. 3 If to sey I know where I go for si God and how to go where E dey, 4 I for komplain gi-am kon tell am all di trobol wey I dey face. 5 I won know wetin E go tok and how E go ansa mi. 6 God go fight mi with all en pawa? No! I nor tink so. E go listin and ansa mi wen I tok. 7 Since pesin wey dey rite with God fit go follow am tok, den E go diliver mi from pipol wey dey judge mi, forever. 8 I don find am go east, but I nor si am. I nor si am for west wen I find am go der too. 9 Wen God dey work for nort and sout, I nor still si am. 10 Yet, God know evry step wey I dey take. If E sey make E test mi, I go klean kom out like gold. 11 Bikos I just dey waka follow God for back; for di road wey E choose by ensef and I nor dey waka on my own. 12 I dey always do wetin E tok; dey follow en words; nor bi my own. 13 E neva shange and nobody fit oppoz or stop am from wetin E won do. 14 E go do wetin E don plan for mi. Na-im dey kontrol my destini. 15 Na dis make mi dey fear and wen ever I si am, my hold body go dey shake. 16 True-true, na God make mi dey fear. E don distroy di mind wey I get. 17 Na God, nor bi di darkness make mi kwayet, even doh di darkness don kover my face. |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.