Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -

Jenesis 10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English


Di Pipol For Di World

1 Na dis bi family wey Noah shidren: Shem, Ham and Jafet born, afta di flood happen.


Jaflet Shidren

2 Jafet shidren na Gomer, Magog, Madai, Javan, Tubal, Meshak and Tiras.

3 Gomer kon born Ashkenaz, Rifat and Togarmah.

4 Javan shidren na Elisha, Tarshish (wey bi Spain naw), Kittim pipol dem (wey bi Cyprus naw) and Dodanim pipol (wey bi Rhodes naw.)

5 Na dem bi di grand-grand papa to di pipol wey dey di land wey wota surround. Na dem bi Jaflet shidren-shidren.


Ham Shidren

6 Ham shidren na Kush, Mizraim, Put and Kanaan.

7 Kush shidren na Seba, Havilah, Sabtah, Rama and Sabteka. Rama shidren na Sheba and Dedan.

8 Kush na Nimrod papa, dis Nimrod kom bi warrior for di eart.

9 En na strong hunta for Oga God front. Dat na why dem dey sey, “Just like Nimrod wey bi strong hunta for God present.”

10 For di first time, en kingdom na Babel wey bi Babilon, Erek, Akkad and Kalneh wey dey Shinar land.

11 From dat land, e kon go Assyria where e for build Nineveh, Rehobot, Kalah

12 and Resen where dey di centre for Nineveh and di great town wey bi Kalah.

13 Mizraim (wey bi Egypt naw) shidren na Lud pipol (wey bi Lydia naw), Anam, Lehab, Naftuh,

14 Patrus, Kasluh (na from dem Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol.

15 Kanaan shidren na Sidon wey bi en first pikin, Het,

16 Jebus, Amor, Girgash,

17 Hiv, Ark, Sin,

18 Arvad, Zemar and Hamat pipol. Leta, Kanaan family kon skata

19 and dia land kon wide from Sidon to Gerar go rish Gaza and from der to Sodom, Gomorrah, Admah and Zeboiim till e rish Lasha.

20 Dis na Ham shidren akordin to dia family, dia language, lands and kountries.


Shem Shidren

21 Dem still born some sons give Shem (wey bi Jafet senior broda) and na Shem bi papa to all Eber sons.

22 Shem shidren na Elam, Asshur, Arfaxad, Lud and Mash.

23 Aram shidren na Uz, Hul, Geta and Mash.

24 Arfaxad na Shelah papa and Shelah na Eber papa.

25 Eber get two sons: One name na Peleg, bikos na en time dem take divide di eart and en broda name na Joktan.

26 Joktan shidren na Almodad, Shelef, Hazar-Mavet, Jerah,

27 Hadoram, Uzal, Diklah,

28 Obal, Abimael, Sheba,

29 Ofir, Havilah and Jobab dem na Joktan sons.

30 Where dem dey stay na from Mesha go rish Sefar for di hill for east.

31 Dis na Shem sons akordin to dia family, language, lands and kountry.

32 Dis na Noah family akordin to dia generashon, kountry and dia pipol kon full di eart afta di rain don fall finish.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Wycliffe Bible Translators, Inc.
Lean sinn:



Sanasan