Isaya 46 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishBabilon Juju 1 “Bel and Nebo town don fall. Dem pak dia juju on-top donkey and naw, di juju too heavy for di donkey to karry. 2 Di juju wey stand before don fall; dem nor fit save diasef and dem don karry di juju dem go as slave! 3 So Jakob shidren-shidren, make una listin; una wey remain for Israel, pipol wey I dey kare for, since dem born una. 4 Even wen una don old kon get white hair, I go still dey kare for una. Na mi kreate una, so I go support, help and save una.” 5 God sey, “Na who una fit take kompare mi? Make una tell mi, abi e get anybody wey fit bi like mi? 6 Pipol dey pour gold from dia bag kon measure dia silva. Dem go hire pesin wey go use di gold make juju for dem and den, kon woship am. 7 Dem go karry am for dia shoulder dey waka kon go put am for where e go dey. E nor go fit komot for where dem put am. Even wen pesin pray to am, e nor go fit ansa or save di pesin from wahala. 8 Una wey dey tok against God, make una remember and tink of all wetin God don do. 9 Make una remember wetin happen before-before! Na mi bi God and e nor get any oda god. Yes! Na mi bi God and nobody bi like mi. 10 I know di end from di biginnin and na from wen I kreate di world I don dey tok tins before dem happen. I sey na as I plan am, na so e go bi and I go do am as I wont am. 11 I koll one eagle kom from east; from one far land, di one wey dey kom do wetin I plan. Just as I tok, na so e go bi and wetin I plan, must happen. 12 So, una wey sturbon and nor dey do di rite tin, make una listin to mi. 13 I dey kom judge and diliver my pipol. E nor go tey again and di time to save dem don near. I go save Jerusalem kon honor Israel pipol.” |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.