Isaya 39 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishMessenja From Babilon 1 For dat time, King Merodak-Baladan wey bi Baladan pikin, for Babilon kon hear sey King Hezekaya dey sick since, so e send leta and gifts go gi-am. 2 King Hezekaya welkom di messenjas kon show dem en propaty, silva, gold, spices, perfumes and evritin wey en sojas dey use for war. E nor get anytin for en store room or kingdom wey e nor show dem. 3 Den Profet Isaya go meet King Hezekaya kon ask, “Where dis men from kom and wetin dem wont?” King Hezekaya ansa, “Dem kom from Babilon wey far well-well.” 4 Di Profet ask, “Wetin dem si for di palis?” Di king ansa, “Dem si evritin, e nor get anytin for di store room wey I nor show dem.” 5 Profet Isaya kon tell di king, “God wey get pawa sey, 6 ‘Time dey kom wen dem go karry evritin wey yor grand-grand papa dem keep kon rish naw go Babilon and nor-tin go remain. 7 Dem go still karry some of yor own shidren-shidren go do slave work for di king palis for Babilon.’ ” 8 King Hezekaya undastand sey, as long as e dey alive, peace go dey for di town, so e ansa, “Di message wey yu give mi from God so, dey good.” |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.