Isaya 12 - Holy Bible Nigerian Pidgin EnglishTanksgivin Song 1 For dat time yu go sey: “Oga God, I praiz Yu, bikos Yu bin dey vex for mi, but naw, Yu dey konfort mi and Yu nor dey vex again. 2 Si! Na God dey save mi. I go trust am and I nor go fear. Na God dey give mi pawa and strent and na-im dey save mi. 3 As wota dey make pesin wey dey hongry for wota, happy, na so too I go happy wen God save mi.” 4 For dat time, yu go sey: “Make wi tank God! Make wi praiz en name! Make wi tell evribody about di tins wey E do! Make wi tell dem how God big and strong rish. 5 Make wi sing give God, bikos of di great tins wey E don do and make di whole world hear di news. 6 Make evribody wey dey for Zion shaut and sing! Bikos Israel God dey holy and great and E dey stay with wi wey bi en pipol.” |
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee
Wycliffe Bible Translators, Inc.