Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -

1 Kronikles 20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English


David Katch Rabbah

1 Di next rainin sizin, for di time wen kings dey go fight, Joab karry en sojas go skata Ammon land; but David stay for Jerusalem. Dem attack, distroy and seize Rabbah town.

2 Ammon pipol juju wear one gold crown for en head wey heavy rish 75 pounds and jewel dey inside am, so David kollect am put for en own crown. E still karry many tins komot from di town.

3 E karry di town pipol kon make dem work with saw, iron hoe and axe. Na so e do with di odas for all di towns for Ammon. Den en and en men, go back to Jerusalem.


Fight Against Filistia Pipol

4 Afta, Israel pipol kon fight again with Filistia pipol for Geza. For dis time, Sibbekai from Hushah kill one giant wey dem dey koll Sippai and dem kon win Filistia pipol.

5 Dem still fight with Filistia pipol and Elhanan wey Jair born, kill Lahmi wey bi Goliat broda from Gat wey e spear tick rish di bar wey dem take dey weave.

6 Anoda fight happen for Gat, where e get one giant wey get six fingers for en hand and six toe for en leg. Na di giants family for Gat, e from kom.

7 E dey trobol Israel pipol, but na Jonatan wey David broda, Shimea born, kill-am.

8 All dis men na giant, Rafa shidren-shidren for Gat and na David with en men, kill dem.

© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

Wycliffe Bible Translators, Inc.
Lean sinn:



Sanasan