1 My brodas and sistas, I know sey I dey tok to pipol wey know di law. Na only wen pesin still dey for life, naim di law dey get pawa for en body.