48 Wen en papa and mama si am, dem sopraiz well-well. Naim en mama sey, “My pikin, why yu do us like dis? Si, mi and yor papa dey find yu for evriwhere since.”