20 So di shepads go back, dey praiz God, bikos of all di tins wey dem hear and si. Evritin just bi as di angel tell dem sey e go bi.