5 Wen Ananias hear di word wey Pita tok, e fall for groun at wons kon die. Dis tin make fear katch evribody wey hear wetin happen.