Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Zekaraya 1:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 so make yu tell di pipol sey, “Dis na wetin God wey dey lead heaven sojas tok: ‘Make una turn kom meet mi and I go kom meet una too, dis na wetin Oga God wey dey rule ova evritin, tok.’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Zekaraya 1:3
33 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na from una grand-grand papa time, una don turn komot from my law and nor gri obey mi. Make una turn back kom meet mi and I go turn kom meet una. But una dey ask, ‘How wi won take turn kom meet Yu wen wi neva leave Yu before?’


Naw, una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi and I go heal una!” “Yes! Wi go kom meet Yu, bikos na Yu bi di Oga wey bi awa God.


Dis na wetin make God sey, “Make una turn from sin kom meet mi naw wey time still dey. Make una give mi una heart. Make una fast, kry and mourn as una dey kom meet mi.


God sey, “Israel pipol, if una really wont turn back kom meet mi, make una distroy all una juju,


Afta I don take dem komot dia land, I go sorry for dem kon bring each nashon kom back to en own land again.


God sey, “Israel pipol, una don sin and oppoz mi, but make una turn from sin kom meet mi!


So God ansa, “I go bring my pipol kom back to mi. I go love dem with all my heart and I nor go vex for dem again.


Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.


Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’


I send my savant, di profets kom meet una sey make una stop di bad tins wey una dey do kon do di korrect tin. Dem warn una sey make una nor woship and serve oda gods, so dat una go kontinue to stay for dis land wey I give una and una grand-grand papa, but una nor gri listin or hear dem.


Dem tell una make una shange di kind life wey una dey live kon stop all di wiked tins wey una dey do, so dat una go kontinue to dey stay for dis land wey God give una and una grand-grand papa.


Israel pipol, make una turn back kom meet di Oga una God, bikos una sin don make una fall.


Wen dem get peace, dem kon sin again and Yu allow dia enemies attack dem. But wen dem turn kom meet Yu for help, Yu hear dem from heaven and Yu save dem many-many times, bikos of yor mesi.


Bikos of dia sofa, dem kon turn go meet Israel God. Dem find am until dem si am.


Make yu go back go meet God; if yu remove wiked tins for yor house, E go karry yu up.


I don remove una sins komot like sey na tick kloud. So make una turn kom meet mi, bikos na mi bi di Pesin wey save una.”


God sey, “If man drive en wife and di woman go marry anoda man, di man go fit go marry di woman again? Dat kind tin go make di land dirty. But Israel pipol, una bi ashawo wey get many husband and naw, una won turn back kom meet mi.


“Naw, yu go ask sey: ‘Wetin make di pikin nor sofa for wetin e papa do?’ Di ansa na sey di pikin do wetin dey rite and good. E keep and obey my law, so e must really get long life.


E go meet King Asa kon tell am, “King Asa, Judah and Benjamin tribe, make una listin to mi! As long as una dey obey God, E go always dey with una. If una koll am, E go ansa una, but if una rijet am, E go rijet una too.


Make una stop all di bad and wiked tins wey una dey do, so dat una go get new mind and heart. Israel pipol, why una like to die?


I nor wont make anybody die.” God wey get pawa sey, “Make una run from sin and una go get life.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka