Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Rut 4:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Den all di eldas wey dey di gate kon sey, “Yes! Wi bi witness. Make God make yor wife bi like Rashel and Leah, wey born many pikin for Jakob. Make yu get plenty money for Efrat and evribody go know yu for Betlehem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Rut 4:11
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So Leah get belle kon born boy. E name am Reuben kon sey, “God don sorry for mi, bikos of my kondishon. True-true, my husband go love mi naw.”


“ ‘Betlehem pipol, una wey small pass for all di pipol wey dey rule Judah, na from among una di pesin wey go lead all my pipol for Israel, go from kom.’ ”


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


Wi hear sey di Kovenant Box dey for Efrat; den wi si am for Jaar town.


(Di man name na Elimelek and en wife name na Naomi. E get two shidren wey bi Mahlon and Kilion. Dem kom from Efrat family wey dey Betlehem for Judah.)


den di woman go waka go meet am for di eldas front kon remove en sandal from e leg den spit for en face. Den di woman go sey, “Make dis kind tin happen to any man wey nor gri keep en broda name for Israel!”


Dem bless Rebekah kon sey: “Awa sista, yu go bi mama to tazon-tazon pipol! Yor shidren-shidren pawa go strong pass dia enemies own.”


Wise woman dey build en house, but foolish woman dey skata en own with en hand.


(Naw Efron sidan with Hit shidren.) Efron wey bi Hit pesin kon ansa Abraham for front of Het shidren and evribody wey dey kom thru di town gate sey,


For morning, Jakob kon find out sey na Leah e sleep with! So Jakob tell Laban, “Wetin yu do mi so! Nor bi bikos of Rashel make mi work for yu? Wetin make yu deceive mi?”


Pipol know en husband well-well and dem dey respet am, bikos e dey sidan with di oda eldas, dey take decision.


(Laban get two girl pikin; di senior one name na Leah and di yonga one na Rashel.


Di sons wey Leah born na Reuben wey bi Jakob first pikin, Simeon, Levi, Judah, Issakar and Zebulun.


Di sons wey Rashel born na Josef and Benjamin.


But if di broda sey e nor go fit marry en dead broda wife, den make di woman go ripot to di eldas for di town gate sey, “My husband broda sey e nor fit keep en broda name for Israel; so e nor gri marry mi!”


Den Jezebel rite leta, sign am with Ahab name, use en seal take seal am kon send am go give di ofisas and doz wey bi leaders for Jezrel.


Salma wey bi Betlehem papa, naim still born Haref wey bi Bet-Gada papa.


I sign and pipol witness evritin wey wi do, den I weigh di money for skale for am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka