20 Naomi ansa, “Make una nor koll mi, ‘Naomi’, but make una koll mi ‘Mara’, bikos God wey get pawa don ponish mi well-well.
God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.
No ponishment dey sweet pesin wen dem dey ponish am, bikos e dey pain. But di pesin wey God ponish, go get life wey nor dey end.
I dey kry evry nite with pain like sey lion dey break my bones, bikos I tink sey God won end my life.
Na since wen I dey small Yu allow pipol dey opress mi and I don nearly die. Yu don ponish mi well-well and naw, na pains full my life.
Na only trobol I dey always get and evry morning dey kause pain for mi.”
den make yu know sey na God handwork bi dis, bikos na-im set trap wey katch mi so.
Na blessing dey follow di man wey God korrect! So make yu nor komplain wen God dey ponish yu for yor sins.
Yu fit find out where God from kom? Or how E take dey get en mighty and strong pawa?
‘Na mi appear to Abraham, Isaak and Jakob as di Almighty God, but di pipol nor know sey my name na Oga God,’ too.
Make di God wey get pawa give una mesi for di man front, so dat e go release Simeon and Benjamin! But for mi, if I luz my shidren, I luz dem bi dat.”
Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.
I nor si any temple for di town, bikos Oga God, di one wey get all pawa and di Lamb, na dem bi di temple.
God sey, “Na mi bi di Alfa and Omega, di One wey dey since, wey dey naw and wey go still kom, na mi bi di God Almighty!”
Den dem rish Marah, but dem nor fit drink di wota wey dey dat place, bikos e bitter (na dis make dem dey koll am, Marah.)
E nor let mi breath well; E don kover my life with bitterness.