Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Rut 1:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Rut 1:1
26 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But honga kon dey di land, so Abram go Egypt go stay der small, bikos di honga strong well-well.


Honga kon dey di land, just as e happen for Abraham time. So Isaak kon go Gerar where Abimelek wey bi Filistia pipol king dey stay.


“Man pikin, if one kountry sin kon disobey mi, I go stop to give dem food chop. I go send betta honga go der kon kill both animal and human being.


E komot for Betlehem go look for anoda place where e go stay. Wen e dey travel, e kon rish Mikah house for di hill kountry wey dey Efraim.


I go break una strong pride; una nor go get rain; una land go dry kon strong like iron.


Naw di honga strong well-well.


God sey, “Na mi make hongry dey una town, but una nor still gri turn kom meet mi.


E kause honga for Kanaan land wen E nor make di groun bear betta food for dem.


Una go plant plenty seed, but na small tin una go harvest, bikos siti-siti go chop evritin wey una plant.


Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals.


Dis na wetin God tell Jeremaya about rain wey nor go fall.


E turn di land wey get fruit to land wey nor get anytin at-all, bikos of di wiked tins wey di pipol wey dey stay der, dey do.


So Elijah go meet King Ahab. Dat time, e nor dey eazy to plant food for Samaria.


Afta Jeftah die, Ibzan wey kom from Betlehem kon rule Israel pipol.


Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”


One day, one Levi man wey dey stay Betlehem for Judah kon kom di aria.


But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.


Salma wey bi Betlehem papa, naim still born Haref wey bi Bet-Gada papa.


Salma sons na: Betlehem, Netofat, Atrot Bet-Joab, half of Manahat and Zor pipol,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka