Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 99:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 So make una praiz di Oga awa God! Make una bow woship am, bikos E dey holy!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 99:5
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make wi go God temple; make wi woship am for front of en throne.


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


My God, make all praiz bi yor own and make dem high pass di heavens. Make yor glory kover di whole eart.


Kom make wi tok about how God great rish; kom make wi praiz en name togeda.


Na God bi my pawa and Savior. Dis na my God and I go praiz am. My grand-grand papa dem God and I go sing about how E great rish.


Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.


For dat time, yu go sey: “Make wi tank God! Make wi praiz en name! Make wi tell evribody about di tins wey E do! Make wi tell dem how God big and strong rish.


So, make wi praiz God great and wonderful name, bikos E dey holy!


Na Yu bi my God and I go praiz Yu! Na Yu bi my God and I go lift yor name high!


Make dem praiz am for where pipol dey and for where di leaders for di nashon gada put,


So make wi praiz di Oga awa God! Make wi woship am for en holy hill, bikos di Oga awa God, dey holy!


My God, make Yu raiz-up with all yor pawa and wi go praiz and sing songs to take celebrate evritin wey Yu don do.


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.


David stand for dia front kon sey, “My kountry pipol, make una listin to mi. I bin won build betta house for God Kovenant Box, where God go stay. I don prepare tins to take build betta temple for God.


Dem don gri sey dem nor go turn kom meet mi. Dem koll mi wey bi di Most High God, but I nor go raiz dem up at-all.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka