Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 97:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 But disgrace dey follow pipol wey dey woship juju; doz wey dey make mout about dia god wey nor bi anytin, bikos evry oda god must bow before di Oga awa God.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 97:7
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But wen God won send en first-born enter dis world, E sey: “Make all my angels woship am.”


All dis bad tins kon turn di pipol to fool and dem nor get sense again. So, disgrace go follow doz wey dey make juju, bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.


But for all of una wey trust juju, wey dey koll image una gods, dem go sofa and disgrace una.”


God tell dem, “Make una nor make juju for unasef or make image, pila, stone kon dey woship am. Na mi bi di Oga una God.


Make una nor do any image like wetin dey heaven, eart or inside wota.


Dem show sey nor bi demsef dem dey work for, but na for una, bikos una hear dis matter from di apostles thru di Holy Spirit pawa wey kom from heaven. Even angels dey wish sey dem know dis tins.


All dis gods dey yuzles; dem nor fit do anytin at-all. Di juju dem dey weak and konfuse and dem nor get pawa at-all.”


If yu add di two angel feada togeda, na 30 fit dem bi. Dem stand well face inside di temple.


‘Anybody wey make juju or image to woship, na curse go follow dat pesin, bikos juju wey human being dey make, na sin to God. Den all di pipol go ansa, “Amen.”


Make una nor make any juju with anytin wey dey heaven; eart or for inside wota.


Di angels go spread dia feada kon kover di box and di angels go face each oda dey look di box.


Wen di pipol for Ashdod wake-up di next day, Dagon don fall for groun for di box front. So dem take Dagon kon put am back for where e suppose dey.


Yu go open blind pipol eyes, save doz wey dey darkness and free doz wey dey prison.


Pipol wey dey make juju, go shame and disgrace go follow dem. All of dem go waka go with disgrace.


So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka