9 Make una woship God with all en glory and wonders. Make all di eart shake fall for en front.
Make una honor God, bikos en name get glory. Make una woship God, bikos of en holiness.
Yu, eart make yu shake with fear, bikos of di Oga wey bi Jakob God,
Wen yu go war, yor pipol go dey happy to follow yu go fight. Na holy garment dem wear for yor body and yor pawa go dey fresh evriday like morning dew.
E go even build small palis for di sea centre near di holy mountin. But wen e go die, nobody go dey der to help am.”
So, make di whole world fear God and make evribody kom bless en name.
Before-before, dem dey make yanga with dia fine-fine tins kon take di tins do juju. So na bikos of dis, God make dia money and propaty dey yuzles.
So, wen una vow give di Oga una God, make una keep una promise. Make evribody bring gift kon give di Holy One!
Ezra kon sey, Make wi praiz di Oga, wey bi awa grand-grand papa dem God! Na-im make di king honor God Temple for Jerusalem like dis.
No wonder dem dey fear Yu well-well! Na who fit stand for yor front wen Yu dey vex?
All di pipol wey gada, woship God. Some dey sing and di odas dey blow trumpet. Dem do like dis till di sakrifice burn finish.
Afta, di king and all di pipol wey dey with am kon bow woship God.
King Hezekaya and all di ofisas tell Levi pipol sey make dem use David and Profet Asaf psalms take praiz God and dem kon dey happy as dem dey praiz and woship God.
Na God bi king! Make di nashons shake with fear! E sidan for en throne where di angels wey get feadas dey and make di eart shake.