Psalms 96:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English4 God dey great! Make all praiz bi en own! E big pass all di oda gods. Uka jalj uñjjattʼäta |
God sey, “Una nor suppose fear mi wey bi God? Why una nor dey shake with fear wen una si mi? Na mi make san as boundary for sea and dis san nor go let di sea flow pass where I sey make e flow rish. Di wave fit karry di sea up-and-down, but e nor go fit pass der. Di wave fit make nois, but dem nor go fit pass di boundary.
I dey ready to build one temple to honor di Oga my God and to dedikate am gi-am. I go burn betta incense for am; offa bread and burnt sakrifice evry morning and evening and for Sabat Day too. I go do di same tin for new moon festival and evry oda tin wey di Oga my God tok. Dis na wetin Israel pipol go dey do.