Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 94:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Raiz-up make Yu judge di pipol for di world kon give proud pipol wetin dem deserve.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 94:2
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies! Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi!


Bikos all of us must stand for Christ front and e go judge us akordin to di tins wey wi do wen wi dey dis eart; weda dem good or bad.


All of una wey dey fear and obey God, make una love am! Bikos God dey protet pipol wey dey loyal to am, but E dey vex ponish doz wey dey do wiked tins.


I know sey Yu nor go do dat kind tin. Yu nor go kill pipol wey dey good with di bad ones.”


For di same way, make una wey yong put body down for di eldas. Make una nor dey karry body up for each oda, bikos God dey oppoz proud pipol, but E dey favor doz wey dey honbol.


Israel pipol go stand fight dia enemies kon kill all of dem finish.


Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.


Di way yu dey karry body up and make mout, don rish my ear and naw, I go hook yor nose and yor mout kon take yu go back thru where yu pass kom.’ ”


“ ‘Who yu tink sey yu dey curse and laf since? Yu nor dey respet mi wey bi Israel God wey dey holy.


But God sey, “Wen I finish wetin I dey do for Mount Zion and Jerusalem, I go ponish Assyria king, bikos e dey proud and e too boast.”


For dat day, God go distroy doz wey dey karry body up kon disgrace sturbon pipol and na only en name pipol go dey praiz.


My God, make Yu raiz-up kon fight for mi. Make Yu remember as dis fools dey curse Yu evriday.


Make God raiz-up! Make all en enemies skata! Make all di pipol wey hate am, run as dem si am.


Make di heaven tok about how E take dey judge bikos na God go judge by ensef. Make di heavens tok about en good judgement, bikos na God bi di judge.


Awa Oga God, Yu nor go judge dem? Wi nor get pawa rish dis plenty sojas wey dey kom attack us so o-o. Wi nor know wetin wi go do, so wi kom meet Yu make Yu help us.”


So my God, make Yu raiz-up kon judge di world, bikos na Yu get all di nashons.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka