“I fine pesin wey fit build di wall; pesin wey fit stand for where di wall for fall kon tok for di town wen my vexnashon won distroy am, but I nor si anybody.
God sey, “Waka round Jerusalem street kon shek for where pipol gada weda una go si any good and raitious pesin. If una si, I nor go ponish di town again.
Afta I tink about am well-well, I kon tok against di ofisas and doz wey get money. I tell dem, “Una dey opress and ponish una own brodas as una dey take intrest wen dem borrow money from una!” Bikos of dem, I kon koll evribody togeda make dem tok for di matter.
Wen e komot from der, e meet Jehonadab, Rekab pikin wey dey find am since. Jehu greet am kon ask, “Yu get respet for mi, just as I get for yu?” Jehonadab ansa, “Yes, I dey respet yu!” Jehu kon sey, “If na so, den shake mi.” So Jehonadab stresh en hand and Jehu kon karry am enter en horse.