Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 93:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 93:5
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont


Yor laws dey wonderful. No wonder I dey obey dem!


Make una honor God, bikos en name get glory. Make una woship God, bikos of en holiness.


“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.


Yor laws always dey rite; so make Yu help mi undastand dem, so dat I nor go die.


Yor rules dey pafet and wi go fit trust dem.


Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God.


Den make una remember God kommand and evritin wey di profets sey go happen. True-true, all di pipol wey dey si vishon, dey tok all dis tins, bikos dia mind dey dark.


So make wi praiz di Oga awa God! Make wi woship am for en holy hill, bikos di Oga awa God, dey holy!


So make una praiz di Oga awa God! Make una bow woship am, bikos E dey holy!


But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.


Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.


Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.


God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”


All of una wey dey karry di temple tins, make una know sey God go save una from Babilon. So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid; make una make unasef holy, so dat una nor go die.


“Yu go take pure gold take make one plate and wetin yu go rite on-top na, ‘Na God holy pass.’


kon tell dem, “Una wey bi Levi pipol, make una listin to mi. Make una dey holy, so dat una go fit make una grand-grand papa dem temple holy! Make una remove anytin wey nor dey klean from God Temple!


“Dis na di temple law: All di aria wey dey near am on-top di mountin, der holy.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka