Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 92:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Wi dey si di great work wey Yu do! Di tins wey Yu dey tink, deep well-well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 92:5
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My Oga God, Yu don do wonderful tins for us. Wetin Yu plan for us too many to kount. Nobody bi like Yu. If I start to kount all di wonderful tins wey Yu don do, I nor go fit kount dem finish.


My God, si as e hard mi to tink about wetin Yu dey tink for mi, bikos dem plenty well-well!


God show us dis tins thru en Spirit, bikos di Spirit dey find evritin; even di deep tins wey dey God mind.


Si how di tins wey God do dey good well-well and na for pipol wey dey obey am.


Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.


All dis wisdom dey kom from God wey dey lead heaven sojas. Na-im dey give pipol wisdom and dey guide us for evritin wey wi dey do.


So my God, make Yu si all di difren tins wey Yu don do! Na sense Yu take make all of dem. Na wetin Yu kreate full di whole eart.


Make una tell God, “Si as di tins wey Yu do dey great. Yu skata yor enemies with yor strong pawa!


E nor go end until E don do evritin wey E plan to do. Di time dey kom wen di pipol go undastand all dis tins well.”


Evritin wey don happen, too hard for human being to undastand; dem too deep for us to tink about.


Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.


As dem dey plan dia evil, dem go sey, “Na betta plan wi dey plan so o-o!” True-true, nobody fit si wetin dey inside human being heart or mind.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka