Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 92:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 E dey good to tank God. Yes! Awa belle dey sweet us wen ever wi dey sing and praiz di Most High God.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 92:1
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make wi praiz God! Si as e dey good to sing praiz God! Yes, na to praiz God bi di rite tin to do!


Make wi tank God, bikos E dey good! En love wey nor dey fail, dey forever.


Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms.


make una praiz am, bikos E dey good! Make una sing praiz en name, bikos dat na wetin una suppose do!


Una wey dey fear God, make una sing with joy; bikos e dey good make pipol wey get pure heart, praiz am.


But for mi, si as e good to dey near God! I don make di God wey get pawa my guide and I go tell evribody about di wonderful tins wey E don do.


So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem.


My God, I go praiz yu forever, bikos of di tins wey yu don do. I go always dey trust Yu, bikos pipol wey dey obey Yu, know sey Yu dey good.


Di Most High God make yor papa Nebukadnezzar get kingdom wey strong well-well and E give yor papa respet, honor and majesty.


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem,


I go just give Yu sakrifice on my own! My Oga God, I go praiz yor name, bikos e dey good and


But Yu, my Oga God, dem go praiz Yu forever.


But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”


I bin sey, ‘Una bi gods; bikos una bi di Most High God shidren.’


True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.”


So, di really “Sabat Day” rest, still dey kom for God pipol.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka