10 no evil go fit tosh una and no wahala or diziz go kom near where una dey.
Wahala nor fit kom meet doz wey dey fear God, but na trobol dey always follow wiked pipol.
God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life.
God go protet una from any kind sickness. E nor go let una sofa from di bad-bad diziz wey una si for Egypt, but E go make una enemies sofa dis diziz!
But if wi put hope for wetin wi nor fit si, wi go take all awa mind wait for am with patient.
Peace go dey yor house and wen yu look yor propaty, evritin go komplete.