7 But God go reign forever and E go dey judge from en throne.
Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.
Naw, my friends, make una nor let dis tin pass una, bikos one day bi like 1,000 years for God eye and 1,000 years bi like one day.
Jesus Christ na di same yestiday, today and forever, e nor dey shange!
God don make heaven en throne and na from der E dey rule evritin.
But Yu, my Oga God go sidan for yor throne forever and evry generashon go know how Yu dey great.
Na raitiousness and justice Yu take make di foundashon for yor throne. Yu dey rule with trut and love wey nor dey fail.
Yu bi God wey nor dey die! Even before Yu kreate di mountins and di whole world, Yu don dey.