15 Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.
My enemies don set trap for mi and I don taya bikos of dia wahala. Dem dig deep pit for where I dey waka pass, but na dem go fall enter by demsef.
Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.
So make wahala kom meet dem at wons! Make di trap wey dem set for mi, katch dem! Make dem fall enter di pit wey dem dig for mi.
Pesin wey like wikedness, na trobol go bi en own and en wahala against oda pipol, go soon end.
So God go pay evil and wiked pipol back, E go distroy dem, bikos of dia sins. True-true, di Oga awa God go distroy dem.
But dia swod go stab dia own heart and dia bows go break.
Yes! I go sing to God, bikos E don save mi.
Naw, I know sey God dey save di king wey E anoint. E ansa di king from en heaven wey dey holy kon save am with en great pawa.
Den I go happy, bikos of my God. I go happy, bikos E save mi.
Make dem tank am with sakrifice kon sing about di tins wey E do.