Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 89:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 ‘I go make en shidren-shidren king forever; dem go sidan for di throne from naw go rish wen di world go end.’ ”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 89:4
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den if yor shidren-shidren obey di kovenant and di laws wey I tish dem, dem go bi king forever.”


E go build temple for mi. I go bi en papa and e go bi my pikin. En kingdom for Israel, go dey forever and ever.’ ”


I go do wetin I promise David yor papa, sey na en shidren-shidren go rule Israel forever.


“Mi, wey bi Christ, I don send my angel make e kom tell di pipol for di church di trut about dis tins. I kom from David family and na mi bi di brite Star wey dey shine for morning!”


Profet Isaya sey, “Somebody dey kom from David family (Jesse rut). E go rule Gentile pipol and dem go bilive am.”


For dat time, God go protet doz wey dey stay Jerusalem and even doz wey weak pass among dem, go dey strong, just as David, dia grand-grand papa bi. David shidren-shidren go lead dem like God angel and dem go bi like God.


en shidren-shidren go bi king forever and en kingdom go dey forever like di sun.


I go gi-am one son wey go take-ova from am and just as di days for heaven nor dey end, na so too en kingdom nor go ever end.


I go always dey sing about God love wey nor dey fail! Both yong and old pipol go hear about how God good rish.


Make di king rule forever; make en kingdom kontinue as long as di sun dey shine. Make blessing dey all di nashons bikos of am, so dat dem go praiz am.


I sey make Yu bless my shidren-shidren; make dem enjoy yor favor forever. God wey get pawa, don promise dis tin and yor blessing go dey with my shidren forever.”


“So di Oga wey bi Israel God don choose mi and my shidren-shidren as king for Israel forever. E sey make Judah tribe dey bring doz wey go lead and na from Judah, E from choose my papa family. And from di family, E kon choose mi as king for Israel.


Make Yu konsida how dem dey disgrace yor savant and how I go must bear all di curse wey pipol dey curse mi.


God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka