Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 89:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 God sey, “I don make kovenant with David, my savant wey I choose. I don promise am sey:

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 89:3
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God promise David di kind promise wey nor go shange sey: “I go put one among yor shidren for di throne.


Wi know sey en na profet, bikos God don promise am sey, naim pikin dem go always bi king for Israel.


I go love and dey kind to am forever and my kovenant with am, nor go ever end.


‘From di time wey I bring my pipol kom out from Egypt, I neva choose any town among Israel land where dem go build temple put to woship mi, but I choose yu, David, so dat yu go rule my pipol.’ ”


Na so God go take bless my shidren-shidren, bikos E don make kovenant wey go last forever with mi: agriment wey nor dey break and promise wey nor dey shange. Na wetin go give mi viktory bi dat and God go make am happen.


but Jesus kon bi priest wen God sey, “I don swear and I nor go shange my mind sey yu go bi priest forever.”


But di time dey kom wen Israel pipol go turn kom meet Oga God and one among David shidren-shidren, go bi dia king. Den dem go fear God and E go bless dem.


My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.


Make God ponish mi Abner, If I nor help David get wetin Oga God don promise am.


Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”


Dem go serve mi wey bi di Oga dia God and na one of David shidren-shidren, go bi dia king.


Yu don forget di kovenant wey Yu make with am kon trow en crown for dust.


E choose David en savant, wen E koll am from where e for dey kare for sheep.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


Before-before, Yu tok thru vishon to pipol wey dey obey Yu. Yu sey, “I don choose sojas and I don selet one yong man from di pipol as king.


God angel komot from Gilgal go Bokim kon tell Israel pipol, “Na mi bring una kom out from Egypt kon put una for dis land wey I promise to give una grand-grand papa and I tok sey I nor go break my promise with una.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka