Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 85:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Yu nor go revive us again so dat yor pipol go happy bikos of Yu?

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 85:6
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My God, I don hear evritin wey Yu do and e sopraiz mi well-well. Even naw for awa time, make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before. Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.


Den wi nor go turn from Yu. Make Yu bring us back and wi go pray to Yu!


Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.


Make Yu satisfy us evry morning with yor love wey nor dey fail, so dat till wi die, wi go always dey sing with joy.


Afta two or three days, E go heal us, so dat wi go fit stay for en present again.


Even doh Yu don make mi sofa well-well, I know sey Yu go make mi happy again kon take mi komot from di pit wey I dey.


Na who go kom from Mount Zion kon save Israel pipol? Wen God don save en pipol, den Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.


Even doh trobol gada round mi, Yu still kom save mi. Yu protet mi from my enemies wey dey vex for mi and yor rite hand kon save mi.


Una go hear am kon shaut with happiness, with joy and belle go sweet una wen una dey do marriage. Una go hear pipol dey sing as dem dey kom tank mi with dia ofrin. Dem go sey, ‘Make wi tank God wey dey mighty, bikos E good well-well and en love dey forever.’ I go make dis land prosper as e bi before. Mi, wey bi God, don tok.”


Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una. Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.


My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?


En love wey nor dey fail don go forever? E promise don fail finish?


Yu go vex and forget us forever?’ All dis na wetin una dey tok, but una still dey do di bad-bad tins wey dey una mind.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka