E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.
Wen dat time rish, sin nor go dey for Israel land again and wikedness nor go dey Judah, bikos I go forgive doz wey I save dia life. Mi, wey bi God, don tok.”
Dis na wetin King Cyrus for Persia tok, Di Oga God for heaven don make mi rule di whole world and E sey make I build temple for am for Jerusalem wey dey Judah.