1 My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back.
E go from Zion kon save Israel pipol! So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.
God sey, “I go bring my pipol kom back to dia land kon sorry for dem. Dem go build Jerusalem again and di king palis go dey as e bi before.
God wey get pawa sey, “But naw, I go sorry for Jakob shidren wey bi Israel pipol kon make dem prosper again. Yes! I go guide my holy name.
So God don rijet mi forever? E nor go ever show mi en love again?
Den God go sorry for di land kon pity for en pipol.
My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.
“ ‘So I don kom back to Jerusalem town kon show dem mesi. Dem go build my temple and di town again.’ ”
“For dat time, wen I don make Judah and Jerusalem prosper again,
I go remember di kovenant wey I make with Abraham, Isaak and Jakob kon fulfil my promise, den give my pipol di land.
Israel God wey dey rule evribody sey, “Wen I don bring di pipol kom back to dia land, dem go tok for Judah sey, ‘Make God bless Jerusalem hill; di holy place wey E dey stay.’
Evritin kon bi 5,400 gold, silva and oda tins and Sheshbazzar karry dem follow body as en and di pipol dey komot from Babilon go Jerusalem.