Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 83:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 All of dem gada togeda and dem dey plan against Yu.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 83:5
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.


Den I si di beast, di kings wey dey di world, dia sojas, as all of dem gada to fight di Pesin wey dey ride di horse and en sojas.


Di kings get di same mind and na di same tins wont. And dem go give di beast dia pawa and authority.


So some pipol kon tell Judah king sey Siria sojas dey for Israel aria, den en and all en pipol kon dey fear, sotey dem bigin shake like tree wey breeze dey blow.


Yor wisdom, brain and undastandin nor mean anytin if God dey against yu.


Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”


But naw, make Yu si how dem dey pay us back. Dem dey kom drive us komot from awa land wey Yu give us!


and since e don know naw sey Mordekai na Jew, e kon sey e go ponish am well-well. E kon dey plan to kill all di Jew wey dey di kingdom.


Den dem kon dey boast dey sey, “Make wi distroy evritin!” So dem burn evriwhere wey wi for dey woship God.


dem for don swallow us alive as dem dey vex.


“Yu si as pipol dey sey I don rijet Israel and Judah pipol; di two family wey I choose? Na dis make dem nor dey respet my pipol at-all, bikos dem nor si dem as strong nashon again.


God wey get pawa sey, “Filistia pipol don revensh and kill Judah pipol well-well, bikos dem hate Judah.


Naw, many nashons don gada against una kon sey, “Make dem skata di town! Make wi look as dem dey distroy Jerusalem.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka