Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 81:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Make una sing and play sheke-sheke. Make una use jita and harp play sweet music.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 81:2
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

with harp wey get ten rope and jita.


Afta dem don sing one hymn, dem kon enter inside Mount Olives.


Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.


If anybody dey sofa among una, make e pray. If anybody dey happy among una, make e sing dey praiz God.


Make Christ word stay inside una and make una dey tish each oda with wisdom wey go make una heart strong. Make una dey sing psalms, hymns and spiritual song and dey do all dis tins to really tank God from una heart.


Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms.


Doz wey dey blow trumpet and doz wey dey sing kon dey sing togeda dey praiz and give God all di glory. With di trumpet, cymbals and oda instruments, evribody kon dey shaut praiz God dey sey: “God dey good! En love and goodness, na forever and ever!” At wons, one kind tick kloud kon kover God Temple.


and doz wey dey sing na: Maaseaya, Shemaya, Eleazar, Uzzi, Jehohanan, Malkijah, Elam and Ezer. Dem play kon dey sing well-well and na Jezrahaya bi di kwayamasta.


Na Yu dey give mi strent, so I go sing praiz to Yu. Na Yu dey guide mi; di God wey show mi en love wey nor dey fail.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka