16 But I go give Israel pipol betta food chop; I go make una beleful with betta honey wey dey flow kom out from di rock.”
E send peace kom una land kon make una chop betta food.
Korn go full una house; wine and olive oil go full where dem for dey press am.
So for di sevent day, as evening dey rish, di men kon tell Samson di ansa sey, “Na wetin go fit dey sweet pass honey or wish tin or animal strong pass lion?” But Samson ansa dem, “If to sey, una nor work with my melu, una nor for know di ansa.”
My melu and goats dey give mi plenty milk and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.
If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.
Dem nor get strent again and dem even dey fear for dia house.