Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 80:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Yu take us from Egypt like grape fruit, den Yu porshu di wiked nashons kon give us dia land.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 80:8
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I bin plant una like special vine wey dem make with di best tins. So na how una kon take turn wiked vine, wey dey produce bad grape?


Yu use yor pawa take porshu doz wey nor dey fear Yu kon give all di land to awa grand-grand papa dem. Yu skata dia enemies kon free awa grand-grand papa.


So di plant grow kon spread for evriwhere like grape tree. Di branches dem grow well-well and en rut strong for groun too. E kon turn to big vine tree wey get many branches and leaf.


Naw, strenjas go distroy my vineyard; skata my farm kon turn di land wey I love to where nobody dey stay.


“Afta, awa grand-grand papa dem karry di Tabanako wey God give dem with Joshua kon drive all di oda tribes and take dia land till di time wey David bigin rule Israel.


Yor mama bi like vine wey dem plant near wota wey get fresh leaf and dey bear good fruits.


Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “Just as dem dey take vine for forest kon go burn am, na so I go take distroy


E porshu di nashons wey dey before dem kon divide dia propaty give en pipol. E make Israel pipol relax for dia house.


“I go porshu di pipol wey dey doz land komot for my pipol, Israel. All of dem wey dey stay di hill kountries from Lebanon go rish Misrefot-Maim, plus Sidon pipol, I go distroy dem, den yu go give dia land to Israel pipol, just as I tok.


My God, nor let dem disgrace mi, bikos I dey koll make Yu kom help mi. Instead, make disgrace follow wiked pipol and make dem die go dia grave, where dem go dey silent forever.


Yu dey trit us with strong hand kon make us drink wine wey dey katch us naw.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka