Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 8:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 8:3
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.


Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.


Si how di tins wey God do dey good well-well and na for pipol wey dey obey am.


God make di moon to mark di mont and di sun dey shine just as God program am.


Na Yu get di heavens and di eart; evritin wey dey di eart na yor own, bikos na Yu kreate all of dem.


From di time wen God kreate di world, E don show us di tins wey ordinary eye nor dey fit si; E show us en pawa and life thru di tins wey E kreate. So wiked pipol nor get eskuse at-all.


But if na God pawa I take dey drive demon komot, den God Kingdom don rish where una dey.


Di juju-men kon tell Fero, “Dis na God handwork!” But Fero heart still strong and sturbon and e nor gri listin to dem, just as God tok.


God too dey big! E high pass di heavens and from der E dey look di stars as dem high rish.


Wen una look di sky kon si di sun, moon and stars and as evritin bi for heaven, make una nor let anytin move una to woship or serve dem, bikos di Oga una God don give dem to di pipol for di eart.


Wen God don tok to Moses finish for Mount Sinai, E kon gi-am two stones wey E rite di kommandment put.


Make di sun and di moon, praiz am! Make all di stars wey dey shine, praiz am!


Di heavens dey show as God glory bi. Di sky dey show how en work big rish.


For God eye, even di moon nor brite and di stars nor shine rish.


Anybody fit kount di angels? Abi e get where God lite nor dey shine rish?


Na praiz pipol dey always praiz am for anytin wey E do. So, yusef must praiz am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka