Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 79:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 My God wey dey save us, make Yu kom help us! Make Yu forgive us, bikos of di glory wey dey yor name.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 79:9
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.


My God, bikos of di honor wey yor name get, make Yu forgive mi my many-many sins.


King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”


But I nor distroy dem since dat one fit stop pipol to obey mi, bikos some kountry don si and hear as I take-take Israel pipol komot from Egypt.


Make Yu remember yor promise and nor hate us. Nor disgrace Jerusalem, di place wey yor throne wey get glory, dey. Abeg, make Yu nor break di kovenant wey Yu make with us.


But bikos of my name, I nor gri ponish una; bikos of my praiz, I nor gri distroy una at-all.


So make Yu forgive us! Make Yu kwik hear and ansa us. Nor bi just for yor town and en pipol, but na to make pipol honor and praiz yor holy name.”


But I nor do am, bikos I nor won disgrace my name. I nor go spoil my name give doz nashons wey si mi wen I dey take my pipol komot Egypt


But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.


Awa sins too many, so Yu don forget us, bikos wi nor dey hear word.


Na Yu bi my rock and my guide. Bikos of di honor wey yor name get, make Yu take mi komot from wahala.


So, make all praiz and glory bi en own, bikos of en free grace wey E give us, thru en pikin wey E love well-well.


Una must honor mi with wetin una dey do, but if una nor gri listin to wetin I dey tok, I go curse una. I go bikos of wetin una do, curse evritin wey una get. True-true, I don already curse una, bikos una nor gri honor mi.


My God! Nor bi wi get di glory! Nor bi wi, but make all glory bi yor own, bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail.


Wen Kanaan pipol and evribody wey dey stay di land go hear wetin happen so, all of dem go kom distroy us and nobody go remember us. My Oga God, wetin Yu go do to keep yor respet?”


But even with all di sin wey wi kommit, Yu still dey forgive and sorry for us.


Dat time, bikos of who I bi, I nor go ponish una as e suppose bi, den una wey bi Israel pipol go know sey na mi bi God.” God wey get pawa don tok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka