Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 79:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 My God, na how long Yu go dey vex with us? Na forever? Na how long yor vexnashon go dey burn like fire?

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 79:5
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So, my God, na how long dis tins go happen? Yu go hide yor face forever, abi Yu go just dey vex like dat?


Abi Yu go dey vex for us forever? Yu go just dey vex even for awa shidren-shidren?


My God, wetin make Yu rijet us forever? Wetin make Yu dey vex for yor own sheep wey dey yor field?


So God sey, “Una must get patient as una dey wait for mi. For di day wen I go attack kon karry all una propaty, I don decide sey, I go gada nashons and kingdoms togeda kon pour my vexnashon on dem. Bikos my vexnashon go full di whole world.


God nor dey ready to forgive dat pesin. Instead, God vexnashon and jealousy go raiz for di pesin and all di curse wey dey dis book go bi en own.


I dey vex naw, so mi wey bi God go ponish dem especially Edom pipol, bikos na dem laf una pass kon kollect una land.


My Oga wey bi God for Heaven Sojas, na how long Yu go dey vex for awa prayers?


Dem dey kry with loud vois sey, “Oga God wey get pawa, how long e go take before yu go judge doz wey dey live for dis eart? Make yu ponish dem, bikos na dem kill us!”


Una gold and silva nor go save una wen God go show as E dey vex rish. En jealousy bi like fire and di fire go distroy di world. Yes, na God make evribody for di world dey fear.


E nor get anoda god like Yu; Yu dey forgive yor pipol wey survive. Yu nor dey vex forever, instead, Yu dey happy to show yor pipol yor love wey nor dey end.


so make Yu nor too vex for us or use awa sins against us forever. Wi bi yor pipol, so make Yu sorry for us.


E nor dey always akuiz pipol or vex tey for dem.


Bikos my vexnashon don kause fire and e don burn rish di part wey deep pass for di grave kon distroy di eart and en plants, den e skata di mountins foundashon.


Dem make am jealous, bikos dem dey serve juju and oda gods.


Make Yu kom back kon help mi. Save mi bikos of yor love wey nor dey fail.


Yu don make us dey chop sorrow like food kon drink tears wey full bucket.


Make Yu remember how my life short rish and how human being life empty and nor mean anytin!


Abi Yu don rijet us forever? Yu go kontinue to dey vex for us?


Den di angel pray to God, “Oga God wey dey mighty, Yu don dey vex for Jerusalem and Judah town for seventy years naw. How long e go take before Yu go sorry for dem?”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka