Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 79:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Blood dey flow like wota for evriwhere for Jerusalem and nobody remain wey go beri doz wey dem kill.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 79:3
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.


And di pipol wey dis fake profets dey profesai to, na war and honga go kill dem too. Dem go trow dia dead body for evriwhere for Jerusalem street and nobody go dey to beri dem. Dis tin go happen to all of dem, dia wifes and dia shidren. I go make dem pay for all di bad-bad tins wey dem dey do.”


And for three and half days, all di pipol, tribes, language and nashons go dey look dia dead body. Dem nor go allow anybody beri dem.


God pipol, di profets and doz wey yu kill for dis world, God don si dia blood inside yu.”


God pipol wey dem kill and doz wey prish about Christ, I si di woman wen e dey drink dia blood and di blood dey shark am like wine. I sopraiz well-well wen I si di woman.


Bikos dis pipol kill yor pipol and profets, so yu don give dem blood make dem drink, bikos na wetin good for dem bi dat!”


As dem rite am, “Bikos of una, wi dey face deat from morning go rish nite and wi bi like sheep wey dem won go kill.”


So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.


I go make dia enemies katch and kill dem, den birds and wiked animals go chop dia dead body.


For dat day, di pipol wey God kill, dia body go skata for difren part for di world. Nobody go mourn for dem and nobody go karry dem go beri. Dem go dey groun like manure wey dem gada.


“ ‘Mi, wey bi God sey, “I go ponish dem for four difren ways: I go make dem die for war. I go allow dog karry dia dead body. I go allow birds and wiked animals chop dia flesh


Just as pesin dey klear and dig groun, na so too wiked pipol bones skata for dia grave mout.


Wetin make Yu allow wiked pipol even get mout to ask sey, “Where dia God dey?” Make Yu revensh dis pipol, bikos dem don kill yor savants finish.


Bikos una don sin against God, I go make una waka dey find road like blind man. Dem go pour una blood for san-san and una body go rotin for groun.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka