Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 79:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 My God, strenjas don take di land wey Yu choose as yor own. Dem don spoil yor holy temple kon turn Jerusalem to where dem dey pour dirty put.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 79:1
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So, bikos of una, I go klear Zion like field; Jerusalem go bi where dem dey trowey dirty put and di temple go turn hill wey grass grow kover.


Dem burn God Temple kon skata Jerusalem wall. Dem burn all di towns wey dem fence kon distroy all dia betta-betta tins.


Dem don tif all wetin e get; all en betta tins don vanish. E dey look as strenjas dey use di holy temple anyhow; di place wey God sey make dem nor enter.


“Wen Hezekaya bi king for Judah, Profet Mikah from Moreshet profesai give di pipol. E tell dem sey, ‘God sey, “ ‘ “Dem go klear Zion like field; Jerusalem go turn where dem dey trowey dirty put and di temple hill go turn forest.” ’


E burn God temple, di royal palis and all di house for Jerusalem. E distroy all di betta-betta house for di town


E take David from where e for dey kare for animals kon make am leader among Jakob shidren-shidren, wey bi Israel God own.


E allow Babilon king kill all dia yong men for dia temple. E nor sorry for di yong men or wimen, or even di old pipol. God give all of dem to Babilon king.


All di good and betta tins wey dey di royal palis and di temple, King Nebukadnezzar pak all of dem. All di gold tins wey King Solomon for Israel make put for God Temple, King Nebukadnezzar remove all of dem, just as God tok.


Yu go take dem enter inside di land kon plant dem for yor mountin; di place where Yu choose as yor house, bikos na Yu wey bi my Oga God, build am as yor own Temple.


But nor measure di temple varanda, bikos God don gi-am to Gentile pipol and dem go mash am for forty-two monts.”


Dem go use swod kill some, karry some as prisona go anoda kountry and di Gentile pipol go distroy Jerusalem, until di time wey God sey Israel must sofa, go end.


God sey, “Skata di temple! Make dead body full inside! Make una start to kill!” So dem start to kill di pipol wey dey for di town.


By dat time, Babilon sojas don burn di royal palis and all di house wey dey Jerusalem rish groun, den dem kon skata di wall.


I bin dey vex for my pipol and na dat make mi allow yu attack dem; but yu nor sorry for dem at-all and yu even dey ponish di old pipol among dem.


Di Almighty One wey bi God don tok; E don gada evribody rite from where di sun for dey raiz go rish where e for dey go down.


Na small time wi spend for yor house before awa enemies drive us kon skata yor temple.


Di pipol sey, “Wi dey shame, dem don insult and disgrace us, bikos strenjas don dirty God temple.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka