Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 76:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Na from heaven Yu dey judge yor enemies; di eart dey shake and dem dey kwayet for yor present.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 76:8
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But Oga God dey en holy temple, so make evribody for di world, keep kwayet for en present.”


So, make evribody kwayet for God present, bikos E dey kom from en holy place.


God sey, “Make una stand for where una dey, den una go know sey na mi bi God! Evry nashon go honor mi and evribody for di world go praiz my name.”


Make evritin wey dey dis world fear God! God don make di world stand and nor-tin go fit move or break am.


From di sky, di stars dey move and fight against Sisera.


God tell Moses, “Make yu use today and tumoro take santify di pipol kon tell dem make dem wosh dia klot


“Make una go meet and ask God for mi and Judah pipol. Make una find out wetin di words for di book mean. God don dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor gri obey wetin dey dis book at-all.”


Bikos God dey great and evribody must praiz and respet am pass oda gods.


“Oga God for heaven! Yu big well-well and wi dey fear Yu. God wey keep en promise with doz wey love and dey do wetin E kommand.


“Na God get pawa pass. E keep en kingdom wey dey heaven for peace.


But na only Yu Oga, bi di true God. Di God wey dey alive and Yu go rule forever. Anytime Yu dey vex, di world dey shake and nobody fit stand wen Yu dey vex.


“Like lion wey run kom from Jordan bush kon katch sheep for fine betta land, na so too I go make Edom pipol run komot from dia kountry. Den di leaders wey I choose go rule di nashon. Bikos e nor get anybody wey bi like mi and nobody fit shalenge mi! Wish ruler fit go against wetin I tok?


Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive en vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire and mountins dey skata to pieces for en present.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka