Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Psalms 76:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 No wonder dem dey fear Yu well-well! Na who fit stand for yor front wen Yu dey vex?

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Psalms 76:7
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na who fit stand wen God dey vex? Who fit survive en vexnashon wey bi like hot fire? En vexnashon dey burn like fire and mountins dey skata to pieces for en present.


Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!


Even angels dey honor am wen dem gada togeda and E great pass evribody wey dey round en throne.


Na who nor go fear and praiz yor name? Bikos na only yu dey holy. Pipol for evriwhere go kom woship yu, bikos dem dey si di good tins wey yu dey do.”


Di angel kon shaut: “Make una dey fear and give God glory, bikos di time wey E go judge di world, don rish. And make una woship di Pesin wey make heaven, eart, sea and where wota from dey flow!”


Abi wi dey try to make Christ vex? Wi strong pass God?


Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body for hell-fire.


If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?


So na who go fit know as Yu dey vex rish? Yor vexnashon strong well-well and e dey make us fear Yu.


Awa Oga wey bi Israel God, Yu dey good. Wi, yor savants wey remain, kom meet Yu and wi dey konfess awa sins. Aldo wi nor get any rite to kom yor present again afta evritin wey wi don do.”


Bikos God dey great and evribody must praiz and respet am pass oda gods.


Den Moses and Israel pipol bigin sing dey praiz God sey, “Wi go sing to God, bikos E don give us viktory. E trow di shariot and doz wey dey ride dem inside di sea.


E trow Fero shariot, all en sojas and strong ofisas inside di Red Sea kon kill dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka